Read this guide in other languages
Dis na list of resources for people wey dey new to contribute to Open Source.
If you see any additional resources wey you wan add, abeg create pull request.
If you get any questions or comments, no fear, create issue. We dey here to help!
Contents
- Any Kind Contribution To Open Source
- Search For Projects From GitHub
- Open Source People Wey Dey Contribute to Mozilla
- Beta Articles For New People Wey Wan Contribute to Open Source
- How Dem Take Dey Use Version Control
- Open Source books
- Open Source Inititatives Wey You Fit Contribute To
- Open Source Programs Wey You Fit Join.
- License
- Introduction to Open Source - Tutorials wey DigitialOcean don prepare wey go help you make better contribution here for Github.
- Code Triage - Tool wey you fit use take find popular repositories and issues to make contribution to. You fit filter them by language.
- Forge Your Future with Open Source ($) - Book wey dey explain open source and how you fit take find project contribute to. E no matter which work wey you dey do for software development.
- Awesome-for-beginners - Github repo with plenty projects wey get well labelled bugs wey new open source contributors fit use start contribution.
- Open Source Guides - Helpful materials for people and companies wey wan learn how to create and how to contribute to open source projects.
- 45 Github Issues Dos and Don’ts - Things wey you suppose dey do and things wey you no suppose dey do for github.
- GitHub Guides - Basic tips and guides on how to use github wella.
- Contribute to Open Source - Sabi how dem dey do things for github while you go dey contribute code to a simulation project.
- Linux Foundation's Open Source Guides for the Enterprise - The Guides wey Linux Foundation don create for Open Source projects.
- CSS Tricks An Open Source Etiquette Guidebook - Book wey Kent C. Dodds and Sarah Drasner write about the kind manners people suppose get for open source.
- A to Z Resources for Students - List of materials wey fit help people wey dey go school learn new programming language.
- "How to Contribute to an Open Source Project on GitHub" by Egghead.io - Step-by-step video of how to start to dey contribute to open source projects for github.
- Contributing to Open Source: A Live Walkthrough from Beginning to End - This step-by-step material on open source contribution get things wey you fit learn from how to choose beta project, work on issue, go reach how to merge pull request.
- "How to Contribute to Open Source Project" by Sarah Drasner - This one dey focus on the main things wey you suppose know when you dey contribute pull request (PR) to another person project for github.
- "How to get started with Open Source" by Sayan Chowdhury - This article dey focus on materials for new open source contributors based on the programming language wey dem like.
- "Browse good first issues to start contributing to open source" - Github don dey help you find issues wey you fit use take start open source contributions.
- "How to Contribute to Open Source Project" by Maryna Z - This complete article na for businesses but individuals fit still use am. E dey talk about why, how and which kind open source projects wey person fit contribute to.
- "start-here-guidelines" by Andrei - This article dey talk about how you fit take contribute to open source if you just dey start. Na mainly for learning and practical purposes sha.
- "Getting Started with Open Source" by NumFocus - This one na Github repo wey dey help new contributors jump the obstacles wey dey make dem never fit start to dey contribute to open source.
- "Opensoure-4-everyone" by Chryz-hub - Repository wey talk about everything wey concern open source. E still dey help people practice git commands and how to start open source contribution.
- "Open Advice" - Na 42 senior men for open source na gather write about the things wey dem wish say dem been know. This na wisdom wey fit boost your knowledge no matter where and how you dey contribute to open source.
- "GitHub Skills" - Improve your skills with Github Skills. Our friendly bot go show you different kind beta beta skills within small time.
- "Ten simple rules for helping newcomers become contributors to open projects" - This article cover different kind rules based on experience wey dem don do on many communities and experience of open source memebers, leaders and observers
- "Step-by-Step guide to contributing on GitHub" - Visual step-by-step guide on the process wey dey involved for open source contribution.
- Open Source with Pradumna - This repo contain resource and materials wey you fit use teach yourself about Open Source, Git and Github.
- "FOSS Community Acronyms" - The repo contain list of abbrevation wey dem dey use for inside the FOSS (Free and Open Source) community, plus their meaning and how to use them.
- "Open Source Fiesta - Open Source Fiesta" - This link contain step-by-step instruction on how to contribute to Github repositories, e still contain git command line cheatsheet.
- "6 Best Practices to Manage Pull Request Creation and Feedback" from Jenna Kiyasu, software engineer wey dey work for DoorDash Engineering.
- "Contribute to the Open-Source Community" - Advantages of open-source software, how to sabi the inner workings of any open source project and how to stiil make the first contribution.
- "Complete Guide to Open Source - How to Contribute" (41:52) - Follow Eddie Jaoude learn how dem take dey contribute to open source software
Find links wey dey point directly to the right issues wey you fit contribute to for Github.
- is:issue is:open label:beginner
- is:issue is:open label:easy
- is:issue is:open label:first-timers-only
- is:issue is:open label:good-first-bug
- is:issue is:open label:"good first issue"
- is:issue is:open label:starter
- is:issue is:open label:up-for-grabs
- is:issue is:open label:easy-fix
- is:issue is:open label:"beginner friendly"
Mozilla don promise better internet plus the opportunity to still contribute to all their open-source projects
- Good First Bugs - bugs wey developers don identify as good starting point for the project.
- MDN Web Docs - Help the MDN team document their web platform as you dey help them fix content issues and platform bugs.
- Mentored Bugs - Bugs wey get person wey fit help you if you hook as you dey work on any fix.
- Bugs Ahoy - Special website wey dem do to dey help Mozilla find bugs for their firefox browser.
- Firefox DevTools - a site dedicated to bugs filed for the developer tools in the Firefox browser. Special website wey dem do to dey find bugs wey affect the developer tools for Mozilla Firefox browser.
- What Can I Do For Mozilla - Check make you see if anything or help dey wey you fit do as you dey answer small questions about your skills and the things wey dey interest you.
- Start Mozilla - Twitter account wey dey tweet about issues wey new contributors fit solve for their Mozilla platform.
Helpful articles and blogs wey dey meant for new contributors on how dem fit take start.
- Finding ways to contribute to open source on GitHub by @GitHub
- How to choose (and contribute to) your first Open Source project by @GitHub
- How to find your first Open Source bug to fix by @Shubheksha
- First Timers Only by @kentcdodds
- Bring Kindness Back to Open Source by @shanselman
- Getting into Open Source for the First Time by @mcdonnelldean
- How to Contribute to Open Source by @GitHub
- How to Find a Bug in Your Code by @dougbradbury
- Mastering Markdown by @GitHub
- First mission: Contributors page by @forCrowd
- How to make your first Open Source contribution in just 5 minutes by @roshanjossey
- I just got my free Hacktoberfest shirt. Here’s a quick way you can get yours. by @quincylarson
- A Bitter Guide To Open Source by @ken_wheeler
- A junior developer’s step-by-step guide to contributing to Open Source for the first time by @LetaKeane
- Learn Git and GitHub Step By Step (on Windows) by @ows-ali
- Why Open Source and How? by @james-gallagher
- How to get started with Open Source - By Sayan Chowdhury
- What open-source should I contribute to by @kentcdodds
- An immersive introductory guide to Open-source by Franklin Okolie
- Getting started with contributing to open source by Zara Cooper
- Beginner's guide to open-source contribution by Sudipto Ghosh
- 8 non-code ways to contribute to open source by OpenSource
- What is Open Source Software? OSS Explained in Plain English by Jessica Wilkins
- How to Start an Open Source Project on GitHub – Tips from Building My Trending Repo by @Rishit-dagli
- Finding Good First Issues by Brian Douglas
- How can I become an Open Source contributor? (The ultimate guide) by Julia Furst Morgado
Tutorials and resources of different levels on how to use version control, especially Git and GitHub.
- Video tutorial for Git and Github by Harvard University - Tutorial by Harvard University, na part of their CS50 Web Development course on how you fit take understand Git and GitHub when you dey work with Git commands.
- Think Like (a) Git - Git introduction for "advanced beginners", wey still struggle, make you for take get simple strategy to safely do experiment with git.
- Quickstart - Set up Git - Learn how dem take dey set up Git locally plus how to set up authentication, along with things wey you fit do next on your learning journey.
- Everyday Git - Small set of git commands wey you go most likely dey use everyday.
- Oh shit, git! - How you fit take escape from common git wahala. You fit still check Dangit, git!
- Atlassian Git Tutorials - various tutorials on how you fit use git.
- GitHub Git Cheat Sheet (PDF)
- freeCodeCamp's Wiki on Git Resources
- GitHub Flow (42:06) - GitHub lesson on how to make pull request.
- Quickstart - GitHub Learning Resources - Git and GitHub learning resources.
- Pro Git - The entire Pro Git book wey Scott Chacon and Ben Straub write and Apress come publish am.
- Git-it - Step by step Git tutorial about how to use thedesktop app.
- Flight Rules for Git - A guide about things wey you fit do when things don get as e be unto git level.
- Git Guide for Beginners in Spanish - A complete guide of slides about git and GitHub wey dem explain for Spanish.
- Git Kraken - Visual, cross-platform, and interactive
git
desktop application for version control wey you fit install. - Git Tips - Collection of git tips and tricks wey people dey mostly use.
- Git Best Practices - Commit Often, Perfect Later, Publish Once: Git Best Practices.
- Git Interactive Tutorial - Learn Git with picture wey go make the explanation dey clear.
- Git Cheat Sheets - Graphical cheat sheets about git.
- Complete Git and GitHub Tutorial (1:12:39) - Full Git and GitHub walkthrough by Kunal Kushwaha.
- A Tutorial Introduction to Git - Beginner tutorial wey git do.
- First Aid Git - Searchable list of questions wey people dey mostly ask about git. Dem gather the answers from people personal experience, stackoverflow and the official git documentation.
- Git by Susan Potter - She show how technical parts of git dey really work so that person go fit understand the inner doings and how git take different from other version control systems(VCSs)
- Git Tutorial for Beginners: Learn Git in 1 Hour - Newcomer video wey Mosh do about git, him still use better picture take explain the basics of git.
Books on everything wey concern Open Source: The Culture, History, Best Practices, etc.
- Producing Open Source Software - Producing Open Source Software na book about the real side of open source development. E dey talk about how better projects dey operate, the things wey the users and developers dey expect, and the culture of free software.
- The Architecture of Open Source Applications - Twenty-four people wey don write open source applications talk about why and how dem dey take dey arrange their software. Dem talk about everything from web servers to compiler to health record management system, dem talk about all theses things so that you fit become better developer.
- Open Source Book Series - Learn more about Open Source and the growing Open Source movement with a complete list of free eBooks from https://opensource.com.
- Software Release Practice HOWTO - This HOWTO dey explain good release steps for Linux and other open source prokects. If you fit folllow these steps, e go dey easy for users to use your code and so that dem go fit help you join hand improve the code.
- Open Sources 2.0 : The Continuing Evolution (2005) - Open Sources 2.0 na collection of beta essays from correct correct technology leaders wey go make you think. These essays na continuation of the better work wey one book wey dem dey call Open Sources: Voices from the Revolution been start
- Open Sources: Voices from the Open Source Revolution - Write-ups na from senior men for open source like Linus Torvalds (Linux), Larry Wall (Perl), and Richard Stallman (GNU).
This one na list of initiatives wey dey gather beginner friendly issues to work on or seasonal events for open-source.
- Up For Grabs - This one carry projects wey get issues wey beginners fit handle.
- First Contributions - You fit make your first contribution within 5 minutes. Na tool and lesson wey go help people wey no too sabi open-source to begin dey contribute for projects. Here na GitHub source code wey dey for the site and go give beginners opportunity to make contribution for inside the repository.
- First Timers Only - This one na list of bugs wey dey labelled "first-timers-only".
- Hacktoberfest - This one na program wey dey encourage open source contribution. You fit win gift like t-shirts and stickers if you fit make at least 4 pull requests for october.
- 24 Pull Requests - 24 Pull Requests na project wey dey promote Open Source collaboration for the month of December.
- Ovio - na platform wey get curated selection of contributor-friendly projects. E get powerful issue search tool and fit let you save projects and issues for later.
- Contribute-To-This-Project - This na tutorial wey go help first-time contributors to participate for inside simple and easy project and get comfortable when you dey use GitHub.
- Open Source Welcome Committee - The Open Source Welcome Committee (OSWC) dey help newcomers join the extraordinary world of Open Source. Come submit your open-source projects with us!
program, internship, or fellowship wey dey hosted by one community to help join beginning contributors with mentors and resources to contribute for open source software projects.
- All Linux Foundation (LF) Mentorships
- Beginner friendly Open Source programs with their timelines
- Cloud Native Computing Foundation
- FossAsia
- Free Software Foundation (FSF) Internship
- Google Summer of Code - program wey dey run every year and na paid program by Google wey dey focused on developers for open-source software development wey be students.
- Girlscript Summer of Code - program wey dey last for 3 months for summer period and e dey conducted by the Girlscript Foundation. Participant for this program dey contribute wella to projects even as sabi mentors dey guide them. If person fit get this kind exposure, na just matter of time before the person begin dey contribute to real life project from the comfort of the person house.
- Hacktoberfest
- Hyperledger Mentorship Program - If you dey into blockchain, this program na for you. You fit contribute to Hyperledger. This mentorship program go allow you get practical exposure to Hyperledger open source development. You go join body with mentor wey dey very active for the Hyperledger development community.
- LF Networking Mentorship
- Microsoft Reinforcement Learning
- Major League Hacking (MLH) Fellowship - remote internship alternative for aspiring technologists where them dey build, or contribute to open-source projects.
- Open Summer of Code
- Open Mainframe - Open Mainframe Project also get him own open-source program and the mentees go get opportunity to better wetin dem sabi about mainframe technology.
- Outreachy
- Processing Foundation Internship
- Rails Girls Summer of Code - This one na global fellowship program for women and non-binary coders where them dey work on existing open-source projects and expand their sabi mentality and skillset.
- Redox OS Summer of Code - The Redox OS Summer of Code na wetin dem dey use for donations to the Redox OS project. Na students wey don show interest and sabi mentality to contribute one or two to Redox OS dem dey select.
- Social Summer of Code - Social foundation dey always offer this two-month long summer program for students to learn about the open-source culture and get involved for the community. Participants dey contribute to real-life projects under the guidance of sabi mentors.
- Season of KDE - The Season of KDE, dey hosted by the KDE community, na outreach program for all individuals across the world. KDE also na international free software community wey dey develop free and open-source software and you fit contribute to KDE through the Season of KDE program.
This work dey licensed under Creative Commons Attribution-ShareAlike 4.0 International License.